The Independent National Electoral Commission (INEC) don criticize all the pipo wey dey chook hand for buying of the Permanent Voter Cards and dose wey dey collect Voters Identification Numbers.
The National Commissioner and Chairman, Information and Voter Education Committee, INEC, Festus Okoye, talk say the pipo wey dey do dis bad thing just dey oppress the voters and because of dis dem no go fit use dea rights on the Election Day. Okoye wey talk for Arise TV yesterday, wey we monitor from our studio, con talk say dem house the data of every voter wey don register for the Bimodal Voters Accreditation System and no be for dea PVCs.
Him talk say the Commission go join 1.4 million temporary staff wey go come from the National Youth Service Corps members and students for university wey dey dea final year.