INEC Don Do Meeting unto Deir Offices Wey Dem Attack

November 11, 2022

The Independent National Electoral Commission (INEC) don call for one quick crisis meeting after agbero attack two of deir offices for Ogun and Osun State on Thursday. Festus Okoye, INEC national spokesperson, talk say the Inter-Agency Consultative Committee on top Election Security (ICCES) go meet today Friday to discuss on top the attack. The commission talk say deir office for Abeokuta South Local Government Area of Ogun State burn throwey reach ground, and dis fire accident don destroy over 65,699 Permanent Voters Cards (PVCs) and 29 voting offices and many others. Okoye talk say na the commission Resident Electoral Commissioner (REC) for Ogun State, Dr Niyi  Ijalaiye yarn dem say Yes o! the accident happen for dat side and na also the Resident Electoral Commissioner (REC) for Osun State, Dr. Mutiu Agboke, report say deir office for Ede South Local Government Area also catch fire burn reach ground. The commission con dey worry say which kin wahala be dis because dem get only 106 days to the 2023 general election, and dis attack fit scatter how dem wan send the election materials go deir offices for round the country.

More Posts