India Don Take Punishment Against Pharmacy Companies Wey Dem Don Fault Dea Cough Syrup Dey Cause Pipo Death. 

July 12, 2023


India Health Minister, Mansukh Mandaviya, don talk say dem don take action against more than 100 pharmaceutical companies based on the deaths wey dey linked to cough syrups wey happun last year.

India dey see demsef as di pharmacy of the world, as dia medicine exports for last year reach more than $24 billion. But for dat same year, Indian-made cough medicine na him dem blame for di death of plenty pikin for The Gambia and Uzbekistan. Afta dem inspect di manufacturing plants, di minister yan say production don stop for 31 companies, and product licenses don cancel or suspend for anoda 50 companies, plus say sample testing don become compulsory before dem fit export any medicine.

More Posts