Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Fed High Court Don Order FG to Pay IPOB Leader N500M

November 2, 2022

The Federal High Court wey dey Umuahia, don order Federal Government to pay N500 million as damages to the Leader of IPOB, Mazi Nnamdi Kanu, for forcefully gabbing am and dragging am from Kenya for June last year.

Yesterday, Justice Evelyn Anyadike wey judge the mata, declare say the way dem catch Kanu from Kenya come Nigeria dey illegal and na serious violation of him fundamental human rights.

Kanu use him lawyer, Mr. Aloy Ejimakor, challenge the “catching and rerurning of Kanu from Kenya without any court warrant”, and demand make dem carry am go the country wey he dey live jeje, dat is Britain, or make dem kukuma carry am go back Kenya where he dey before dem gbab am since June 19, 2021.