Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

House Of Reps Don Ask CBN Make Dem Stop Social Media Details As Demand For Bank Customers.

July 12, 2023

The House of Representatives don tell di Central Bank of Nigeria (CBN) say make dem “stop the implementation” of di directive wey talk say make banks add customers’ social media handles as means of identification.

The House, for one resolution, dey worry say if di directive begin work, Nigerians wey no dey use social media, but get big money from dia businesses and trades, go dey excluded from formal banking systems. Dem also dey concerned about di suffer wey di directive go cause millions of Nigerians, especially di pipo wey no sabi book or na semi-literate business owners wey dey live for villages and rural areas wey no get social media handles.

More Posts