Guinea military junta, wey seize power for coup for September 2021, don dissolve the government.
Dem announce am for a presidential decree wey the Secretary General of the presidency, Brig Gen Amara Camara read for state TV on Monday.
Camara no talk the reason why dem dissolve the government or when dem go set up another one.
Dem also order the ministers wey dey the dissolved government to submit their passports and official vehicles.