Governor Dauda Lawal tok say di restructuring of government ministries and agencies na to reduce di cost of governance and improve di quality of service delivery.
Dis restructuring go also affect other government departments, agencies, and parastatals to make sure say dem dey effective, functional, and avoid repetition.Lawal confam say dem go appoint pipo wey get proven integrity and dey hardworking to take charge of di ministries, so dem fit enhance governance and develop di state.