Ghana Supreme Court don dismiss di cases wey challenge di anti-LGBT bill

December 19, 2024

Ghana Supreme Court don dismiss two cases wey challenge di constitutionality of di Human Sexual Rights and Family Values Bill.

Di seven judges for di Supreme Court panel rule say di bill fit go ahead, clearing road for President Nana Akufo-Addo to sign am into law. Dis bill na one of di most strict anti-LGBTQ laws for Africa.

President Akufo-Addo bin delay to sign di bill while dem dey wait for di court decision. If e enter law, people wey identify as LGBT fit face three years for prison, while those wey form or fund LGBT groups fit get five years sentence.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/cbn-don-put-n1-2-million-daily-transaction-limit-for-pos-agents/

More Posts