Former Head of State, Ibrahim Babangida, don talk say MKO Abiola win di June 12, 1993 election

Former Head of State, Ibrahim Babangida, don talk say MKO Abiola win di June 12, 1993 election

February 21, 2025

Nigeria former Head of State, Ibrahim Babangida, don publicly admit say di late Moshood Kashimawo Olawale Abiola win di annulled June 12, 1993 presidential election, after about Thirty-Two years. Di revelation dey inside Babangida book wey e title “A Journey in Service: An Autobiography of Ibrahim Babangida,” wey e launch yesterday. Inside di book, he talk say di decision to annul di election na because dem dey act in extreme national interest so Nigeria fit survive.

Meanwhile, di Chairman of Dangote Group, Aliko Dangote, and di Chairman of BUA Group, Abdulsamad Rabiu, been part of di dignitaries wey raise billions of naira to set up a presidential library for Babangida. Dangote wey praise di former military ruler say na him establish private sector for Nigeria, announce donation of N6 billion, plus say e go support di project wit N2 billion every year for four years. Abdulsamad on top e side, also hail Babangida for di book and presidential library launch, plus e announce donation of N5 billion for di project.

Other people wey donate include Theophilus Danjuma wey give N3 billion; Senate President, Godswill Akpabio, donate N50 million.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/nigeria-don-hit-record-5543-megawatts-mw-for-power-generation/

More Posts