FIFA has confirmed that the inaugural Women’s Club World Cup will take place in January and February 2026.

First Women’s Club World Cup go happen for 2026

May 16, 2024

FIFA don confirm say the first Women’s Club World Cup go happun for January and February 2026.

This tournament go get 16 teams and e go dey happen every four years. E go fall inside the domestic season for European leagues, between the Women’s Champions League group stages and the knockout rounds.

FIFA for their congress wey happun today for Bangkok, also approve new international match calendar from 2026-2029, wey dem aim to give players more time to rest and recover by reducing the number of international breaks from six to five.

The FIFA congress still get to vote for the host of the 2027 Women’s World Cup, and Brazil dey go against joint bid from Belgium, Germany and the Netherlands.

For more news https://naija102.com/blog/

More Posts