Fireboy DML don drop new album wey dem call “Adedamola"

Fireboy DML don drop new album wey dem call “Adedamola”

August 30, 2024

Fireboy DML don drop new album wey dem call “Adedamola,” featuring legends like Lagbaja and Seun Kuti, plus Lojay and Jon Baptiste, for di 14-track album.

Fireboy, wey premiere di album for Naija 102.7FM’s Morning Runs with Beccablisse, talk say di album dey personal to him, na why e name am after himself.

E reveal say ‘Obaa Sima’ na im favorite song for di album and e dey hope say im fourth album go unlock new afrobeats trend for Africa.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/dtigress-don-dey-8th-position-for-di-latest-fiba-world-ranking-women/

More Posts