Finland Prime Minister, Sanna Marin, see serious negative reaction after dem see her dey rock for party for inside one leaked video.
For the footage, wey be like wetin dem take from social media, dem see she and friends, including celebrities from Finland, dey dance and groove.
Opposition party don dey ontop her case case since, and one leader sef say she must to go do drug test.
Ms. Marin na 36 years old, and she don deny say she no take any yeye drug, say na only shayo she shayo “in a party way”.
Ms. Marin no dey hide am say she like party too much as dem don snap am plenty time for different music festivals.
Last year she gats apologize say she go club after she come in close contact with Covid-19 case.