FG dey face N13 trillion wahala for ongoing highway projects

August 23, 2024

Minister of Works, Dave Umahi, don talk say dem need N13 trillion to complete ongoing highway projects wey dis current administration inherit. Umahi yarn dis one when im de brief newsmen yesterday for Abuja. E talk say dem inherit 18,932.50km of ongoing projects wey dey valued at N14.42 trillion as of May 2023.

According to am, di funding gap fit increase reach over N16 trillion when dem review all di projects to reflect how market don change.

E also lament say di high cost of construction materials for market and poor funding of highway projects, plus di underfunding of FERMA for effective road maintenance, na di challenges dem de face.

As e dey talk about some of di achievements within di year, e note say dem don at least execute 90% of di new capital project for di supplementary budget of 2023.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/the-federal-government-don-increase-passport-fees/

More Posts