Federal Government Don Yarn Us Say Dem Go Bring Back Face Mask Order So Dem Go Fit Stop Bacteria Diseases (Diphtheria) Wey Don Break Out For Some States.

October 4, 2023

To tackle the increasing Diphtheria outbreak for different parts of the country, Federal Government don yan leaders for the affected states and the general public say make dem make wearing face masks for public gatherings compulsory. Dr. Faisal Shuaib, wey be the Executive Director/CEO of the National Primary Healthcare Development Agency, talk this one for Abuja today. E talk say places like Kano, Yobe, Katsina, Borno, Kaduna, and Bauchi dey feel the heat as dem get 97% of all the cases wey dem report. According to am, this sickness wey dey spread through air, dey affect pass 73% of pikin wey dey between 1 to 14 years, and 18% of the affected people no receive vaccination.

Dr. Faisal Shuaib talk say government don start big vaccination campaign to solve this problem. Dr. Ifedayo Adetifa, wey be the DG of Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), tell people say make dem no dey share information wey dem no confirm from official government channels. Dem talk say as of today, 3rd October 2023, dem don report 13,204 cases wey dem suspect, and out of these, 8,406 cases don confam for 114 Local Government Areas across 19 States plus the FCT.

More Posts