Federal goment wan suspend degree certificates from more African countries.

January 4, 2024

Federal goment don suspend “accreditation and evaluation” of degree certificates from Benin Republic and Togo. Dem talk say dem go extend di sanction to oda countries like Uganda, Kenya, and Niger Republic. Education Minister, Tahir Mamman, confam di development during one interview, and e talk say undercover journalist don expose how e take get degree from Benin Republic for less dan two months and still serve for NYSC. Goment don suspend accreditation for di two West African countries and start investigation wey dem go submit report afta three months. Minister talk say security agents go pursue those wey get fake certificates from foreign countries and dey use am for Nigeria.

More Posts