ECOWAS CHAIRMAN, President Bola Tinubu Don Slam More Money Punishment On Top Niger Republic. 

August 9, 2023

President Bola Tinubu, wey be Chairman of Economic Community of West African States (ECOWAS), don tell Acting Governor of Central Bank of Nigeria (CBN) make e put extra financial sanctions on Niger Republic sake of di recent coup wey remove Democratically elected Government of Mohammed Bazoum. Di Special Adviser to di President for Media and Publicity, Ajuri Ngelale, wen yarn with State House Correspondents, talk say di sanctions go target military junta, plus di pipo and groups wey get link with di coup.

Raliat Adenekan, our tori pesin, report say Mr. Ngelale make am clear say di 7-day ultimatum wey regional bloc (ECOWAS) give Niger no be Tinubu personal or Nigeria own palava against Niger Republic. E add say dem still dey try persuade and yarn with Niger, and dem go take beta decision and consensus during ECOWAS extraordinary summit wey go happen for Abuja on Thursday.

More Posts