American rapper, P Diddy, wey im real name be Sean Combs, don settle matter with im former girlfriend, Cassie, on top di rape and assault charges wey dem bin carry go court. Dem settle amicably, and Diddy talk for statement say dem decide to settle di case outside court. Cassie, wey full name be Casandra Ventura, bin yan say she want $30 million for damages, talk say her on-and-off relationship with Diddy wey last for ten years bin get wahala of physical, sexual, and emotional abuse. She talk say during dat time, she dey forced to do sexual tins with male prostitutes as Diddy dey watch, masturbate, and record videos. Diddy attorney deny all her claims, talk say na just to collect money she dey find.
-
26, Keffi Street, Off
Awolowo Road, Ikoyi, Lagos -
+234 810 013 0349
09090001905