The Minority Caucus of House of Representatives say the attack wey jaguda pipo attack PDP Presidential Campaign Rally for Kaduna State capital on Monday dey against the peace accord all the whole political parties hold hand sign togeda.
The caucus on Tuesday for Abuja, through dia minority leader of the House of Representatives, Hon. Ndudi Elumelu, use strong language inside statement take tok how the thing the thing no take make sense and say e be like say na some pipo wey get interest inside APC gada the jaguda pipo.
He tok say the attacks fit to make Nigeria democracy miss road if dem no look am well well as he called the national peace committee and the security agencies to investigate the mata and put confam security measures for ground ahead of the 2023 general elections.