DHQ don yan say make people wey wan use military camouflage form for Off-Cycle gubernatorial elections for Kogi, Bayelsa, and Imo, make dem no try am, else dem go face shoot-at-sight. Maj. Gen. Edward Buba, wey be Director Defense Media Operations (DDMO), talk am for Abuja yesterday, talk say military dey ready to tackle any wahala wey fit happen for the election. E yarn say if any soldier dey involved for any yeye tin, dem go face court martial and carry di koko of their action.
