Dem don honour Tanzania founding father Julius Nyerere with statue outside the African Union headquarters for Ethiopia’s capital, Addis Ababa.
Nyerere be the person wey lead what be Tanzania today, from independence for 1961 until 1985. The man be pan-Africanist wey host fighters wey no dey in support of white minority rule for southern Africa.
E play key role for the creation of Organisation of African Unity, wey later become the African Union.