Dem don confirm Trump former personal Lawyer as US judge

July 30, 2025

US President Donald Trump former personal lawyer don get Senate confirmation on Tuesday to become federal judge for appellate court with lifetime appointment.

Despite serious wahala from Democrats wey even waka comot from Senate committee meeting earlier this month, the Republican-controlled Senate still confirm Emil Bove as judge for 3rd US Circuit Court of Appeals with 50-49 vote.

Even though two Republican Senators — Lisa Murkowski from Alaska and Susan Collins from Maine — vote against am, the Republican majority wey be 53-47 still carry the matter go.

Trump former lawyer wey be federal prosecutor before, don get nominated as judge when e dey serve as number three person for Justice Department.

But wahala full ground as people vex well-well. Senator Dick Durbin talk say Bove no get better qualification pass say e dey loyal to Trump anyhow. Dem even accuse am say e support the people wey storm Capitol on January 6 and sack prosecutors wey wan hold dem.

The Third Circuit wey Bove go dey work cover Delaware, New Jersey and Pennsylvania.

Senators Cory Booker and Andy Kim from New Jersey talk say Bove get bad record — say e dey misbehave, break ethics, and no dey respect judicial rules.

Before dem vote am, over 900 former Justice Department lawyers write letter say e no make sense to promote person wey don disgrace the department to high court level

Over 75 retired judges don write Senate committee say e no make sense make president nominate im own criminal defense lawyer as federal judge.

Bove na the lawyer wey represent Trump for New York case wey end with 34 counts of fake business records to hide hush money wey dem pay porn star.

E still defend Trump for two other federal criminal cases wey no reach court before dem cancel am after Trump win 2024 election.

Earlier this year, Bove tell federal prosecutors make dem drop bribery and fraud case wey dem get against New York Mayor Eric Adams. That move cause plenty people resign for Manhattan US attorney office and Justice Department for Washington.

Bove don deny say e do am as exchange make the Democratic mayor support Trump immigration crackdown.

More Posts