Dis na afta di Indonesian city komot as hosts because di Indonesian goment no release di budget for di Games, wey no giv di Association of National Olympic Committees (ANOC) time to find anoda place.
Bali bin dey plan to host di second edition of di World Beach Games wey include 14 sports like beach soccer, beach volleyball and surfing.
E dey important to note say Indonesia bin lose di rights to host di 2023 FIFA Under-20 World Cup earlier dis year afta di kontri football federation (PSSI) tok say dem cancel di draw because di governor of di largely Hindu island of Bali bin refuse to host Israel team.