Chad tags Sudan’s airport threat as ‘declaration of war’

March 25, 2025

Chad don condemn di threat wey one senior Sudanese general make to attack im airports, say na “declaration of war.”

Di country foreign ministry talk say if Sudan try threaten even one square metre of Chad land, dem go respond based on international law.

Dis warning come after Lt-Gen Yasir al-Atta, wey be deputy commander of Sudan army, talk say UAE dey use Chad airports to send weapons to di paramilitary Rapid Support Forces (RSF).

UN experts don talk say di accusation wey Sudan make against UAE get “credible” evidence, but UAE don deny di matter.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/jamb-don-shift-2025-mock-utme-go-april-10/

More Posts