CBN Governor don promise say Nigeria Inflation rate go drop for 2024

February 7, 2024

As e dey so, di Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, Yemi Cardoso, talk say di inflation wey dey disturb Nigeria go drop from 28.92 percent to 21.4 percent for 2024.

Cardoso yan dis one as e dey address di House of Representatives. Im talk say di reason wey dem project dis kind decline for di inflation be because of di inflation-targeting policies of di Federal Government, and improvement for agricultural productivity, plus di global supply chain pressure wey dey reduce, go help reduce inflation for di country.

Im still talk say di demand for foreign exchange for Nigeria dey high now, and e dey make Naira value dey fall because of di increase for di demand for forex wey dey caused by forex demand from speculation, di scarcity of forex because of crude oil money wey dem never remit to CBN, increase in money wey dey comot from di country, and excess money wey dey di economy because of government activities.

Cardoso still talk say di change wey dem do to make market decide di exchange rate na to make sure say dem fit create stable macroeconomic environment, and stop people from holding forex.

More Posts