The Governor of Central Bank of Nigeria, Godwin Emefiele, don use mouth announce say the bank go release new Naira notes by December 15, 2022.
Yesterday for press conference for Abuja, the CBN Governor, Mr. Godwin Emefiele, tok say the highest bank don collect approval of President Muhammadu Buhari to change the N200, N500 and N1,000 notes, wey dem go begin release from December 15th, while dem go continue to use the ones wey dey until Jan. 2023.
He tell Deposit Money Banks wey currently get existing denominations for dia hand to begin return dem back to CBN sharp sharp.
He tok say, throughout dis exercise, dem don suspend bank charges for cash deposit with immediate effect.