Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Aviation Minister don summon heads of agencies way concern air safety.

November 28, 2023

Minista of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don summon heads of regulatory agencies for di ministry to address recent safety concerns for di aviation sector. Regarding di plane diversion incident to Asaba, Delta state, di Minister talk say dem don start full assessment of di matter, and anybody wey dem find guilty go face sanctions for di landing error. For di course of di investigation, di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) don suspend di Wet lease of di Airline wey dey involved.

Di Aviation Minister still talk say e dey concerned about di unfavorable agreement wey di previous administration enta with Ethiopian Air for di failed Nigeria Air project. E talk say, while dem still suspend di operations of di Carrier, dem don submit audit reports to President Bola Tinubu for further action.

More Posts