Australia go start to enforce stricter visa rules for foreign students dis week, as official data show say migration don reach anoda record high, wey fit make di already tight rental market worse.
From dis Saturday, di English language requirements for student and graduate visas go increase, and di government go get power to stop education providers from dey recruit international students if dem dey constantly break di rules.
Dem go also introduce one new “genuine student test” to further reduce di number of international students wey dey come to Australia mainly to work, and dem go put “no further stay” conditions for more visitor visas.