APC NEC Don Pick Former Kano State Governor, Ganduje As National Chairman, Basiru As Secretary.

August 4, 2023

President Bola Ahmed Tinubu don yan again say e dey committed to make our country economy and make policies wey go work well well for ordinary people. The president yan dis one yesterday for Abuja during di National Executive Committee (NEC) meeting of di APC, where Dr Abdullahi Ganduje, wey be former Governor of Kano State, and Senator Ajibola Basiru, wey be spokesperson for di 9th Senate, enta to replace di immediate past National Chairman and secretary.

President Tinubu wey also talk say make everybody join bodi like 5 and 6, come still yan say make members give support to di chairman and secretary, make dem give power to di NWC to fit find people to fill oda positions after dem don yan well. As dem dey di event, di new APC National Chairman sef promise say e go start work sharp-sharp to make sure say di ruling party carry win for di November 11, 2023 governorship elections wey dey Imo, Kogi, and Bayelsa.

More Posts