Wahala don burst for camp of rulling party All Progressive Congress (APC) as dem dey confused for hours after principal officer emerge for di 10th senate.
Na afta Senate President Godswill Akpabio announce di new officers, Chairman of APC, Abdullahi Adamu, come talk say di list of principal officers no come from di party secretariat.
Adamu bin yan dis tori for meeting wey im get with PROGRESSIVES GOVERNORSβ FORUM wey Governor Hope Uzodimma of Imo State dey lead. Uzodimma come yan say di party go handle di “communication gap” wey dey between di four most senior NASS leaders and APC.
Senate President bin announce Senator Opeyemi Bamidele from Ekiti State as Senate Leader, Senator Dave Umahi from Ebonyi State as Deputy Senate Leader, Senator Ali Ndume from Borno State as Chief Whip, and Senator Lola Ashiru from Kwara State as Deputy Chief Whip.
Akpabio sef announce di names of minority principal officers; Senator Simon Davou (Plateau North β PDP, Minority Leader), Oyewunmi Olarere (Osun West β PDP, Deputy Minority Leader), Darlington Nwokeocha (Abia Central β LP, Minority Whip) & Rufai Hanga (Kano Central β NNPP, Deputy Minority Whip).
For House of Reps sef, Tajudeen Abbas announce Julius Ihonvbere (APC β Edo) as House Majority Leader, Halims Abdullahi (APC β Kogi) as Deputy Majority Leader, Bello Kumo (APC β Gombe) as Chief Whip, and Adewunmi Onanuga (APC β Ogun) as Deputy Chief Whip.