Angola Don Comot OPEC Oil Gang Cause Of Quarrel On Top The Products Dem Dey Sell-out.

December 22, 2023

Angola don talk say dem dey LEAVE di oil producer’s organization, OPEC, because of wahala wey concern oil production quotas. Diamantino de Azevedo, wey be di oil minister for di African nation, yan say Angola “no dey gain anything by remaining for di organization,” wey e join since 2007. Angola and Nigeria na di two biggest oil exporters for sub-Saharan Africa.

Dis decision come afta di 13-member cartel and 10 other nations bin agree last month to reduce oil production more for 2024 to try hold up global oil prices. Currently, Angola dey produce about 1.1 million barrels per day, out of di 30 million wey OPEC dey produce as a whole.

More Posts