Wahala dey as Madam Judith Amaechi, wey be wife of former Rivers State Governor Rotimi Amaechi, don come out deny tori wey Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike yarn say she dey collect N4 billion every month from Niger Delta Development Commission (NDDC).
Judith tok this one through her media aide, Dr Dike Bekwele, for statement wey drop on Tuesday. She challenge Wike make he show the forensic audit report wey go prove say she or her NGO, Empowerment Support Initiative, really collect the money or get wahala inside the matter.
But Wike no back down. For interview wey he do with Channels Television, he talk say na through the NGO the money dey pass go Judith side. He even talk say make President Bola Tinubu release the forensic audit report of NDDC sharp sharp. And if him claim no dey inside the report, he go resign from him minister work.
For statement wey drop on Tuesday, Madam Judith Amaechi don talk say wetin Nyesom Wike yarn about her no just be lie but e wild and e no get head at all.
She don challenge Wike make e bring out him own version of di forensic audit report wey go show say she or her NGO, Empowerment Support Initiative (ESI), really chop any money or dey inside wahala.
“We dey challenge Mr Wike sharp-sharp make he publish him own audit report wey show say Dame Judith Amaechi or ESI dey among people wey collect NDDC money illegally,” di statement tok.
Dem talk say, if Wike no fit provide forensic audit report wey show say Dame Judith or her NGO, Empowerment Support Initiative (ESI), collect N4 billion every month from NDDC, make he follow him bold mouth and resign as FCT Minister with full chest and tender apology to Nigerians.
Di statement still yarn say instead make Wike dey use live TV do media trial like film show, make he relax and wait make the forensic audit report finally come out.
According to dem, wetin Wike talk for that interview na wild allegation wey no get ground. Dem call am “blackmail wey no make sense,” wey just dey try rubbish Judith Amaechi name and her work.
“Normally, we for ignore di minister ranting. But e too much now. Nigerians need to know say this talk no get fact, and na attempt to spoil madam reputation,” di statement talk.
Dem fire say Wike just dey drop talk anyhow without even small respect or correct fact, say na just gra gra to chase political relevance.
“For di record, and as we wan scatter dis lie, we dey talk say wetin Wike yan no true at all, and we dey clear am with these points:
“Nothing true dey inside wetin Mr Wike talk against Dame Amaechi and di Empowerment Support Initiative (ESI).”
“Dame Amaechi never collect and no dey ever collect N4bn from Niger Delta Development Commission, NDDC.”
“Empowerment Support Initiative (ESI) register well for 2011 as NGO with Corporate Affairs Commission, and dem don get partnership deal with development people dem, including NDDC.”
Dem still explain say di partnership between ESI and NDDC na correct one wey be say both of dem put hand for ground to run better training and capacity programs for youth and women.
“Dis partnership don dey go well since e start, ESI and NDDC dey satisfied with how e dey run. Plenty youth and women for Niger Delta don gain from di programs to help dem stand on their own and build better life.”
“Unlike di lie wey Mr Nyesom Wike dey spread anyhow, di joint funding between ESI and NDDC dey open for everybody to check. Nothing hide inside.”
Dem talk say anybody wey still dey doubt fit go look di records wey dey public to confirm everything. Di matter still dey hot, and people dey wait make Wike bring receipts or do wetin he promise.