Former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, don talk say all di coalition leaders go support whoever emerge as presidential candidate for African Democratic Congress (ADC) come 2027 general election. He yarn dis one on di same day wey ADC talk say President Bola Tinubu policies never help reduce Nigerians suffer.
Amaechi talk say di opposition dey united and dem go support any candidate wey come out from free and fair primary. He also call on Rivers people make dem register with ADC to help remove APC from power.
Meanwhile, former Jigawa State governor and PDP chieftain, Sule Lamido, talk say he ready to work with any arrangement wey go help secure Nigeria in 2027, whether inside PDP or outside. But he clear say he no go join any coalition or enter ADC at all.
Di former chieftain of di All Progressives Congress still cry out say hunger and hardship don full ground for di country. He come call on every person wey come from di oil-rich Rivers State make dem register under ADC and help remove di ruling APC for di 2027 general elections.
“Every Rivers man wey get good mind for di state and di country suppose register with di new party make we fit remove di current goment and stop di hunger wey dey worry everybody.
“If you never tire for President Tinubu, me I don tire for President Tinubu. If you never dey hungry, me I dey hungry. If rich men dey spend N4 million every month for light, na only God sabi how una dey survive. And di President talk say e no send. Di President talk say e no come to make you happy but ADC come to make you happy.
“Rivers State don get bad name for writing (election) result. When dem write result, dem go talk say dem don win. I no go work with una if una dey follow those wey dey snatch result to announce winner. God go bless all of us,” na wetin di former Rivers governor tell him supporters wey full Port Harcourt International Airport, Omagwa.
Amaechi trek about three kilometres inside Port Harcourt go him house for Old GRA, like say na challenge to di FCT minister, Nyesom Wike, for popularity inside di oil-rich city.