Adiyan Water project go provide 70 million gallons of water everyday for Lagos state

February 6, 2025

Phase two of di Adiyan Water Works project for Ogun State go supply Lagos people 70 million gallons of water every day when dem finish am.

Governor Babajide Sanwo-Olu talk dis one today as e go inspect di facility wey dem first award di contract for 2012.

Before di governor talk, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn say di state government dey committed to make sure Lagos people get enough pipe-borne water.

Lagos State Water Corporation General Manager, Mukhtaar Tijani, still assure say di contractor go complete di project as e suppose be.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/president-tinubu-don-increase-2025-budget-to-n54-2-trillion/

More Posts