6,000 prisoners don escape from Mozambique prison

December 27, 2024

Prison riot for Mozambique capital, Maputo, don leave 33 people dead and 15 others injured.

Di Mozambican police chief, Bernardino Rafael, talk say di prisoners seize weapons from di warders and begin free other detainees.

Di kasala happen after di Constitutional Council confirm di ruling Frelimo party as di winner of di October 9 elections.

Rafael blame di protests wey dey outside di prison for di riot, but Justice Minister Helena Kida talk say di wahala start inside di prison and no get anything to do with di protests.

Out of di 1,534 prisoners wey escape, dem don catch 150 back. Meanwhile, prison break attempts also happen for two other prisons.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/osun-state-governor-don-pardon-53-prisoners-including-one-boy-wey-dem-sentence-to-death-for-stealing-chicken/

More Posts