2027: ‘Coalition of confusion’ – Tinubu dey mock ADC as Yilwatda become APC chair.

July 25, 2025

PRESIDENT Bola Tinubu, yesterday, take swipe for the coalition‑backed African Democratic Congress, ADC, talk say na ‘coalition of confusion.

As e dey speak for the 14th meeting of National Executive Committee (NEC) of APC, where Prof. Nentawe Yilwatda emerge as new national chairman, President Tinubu tok say: “E no bad if person comot from ship wey dey sink and no join coalition wey dey confuse people.”

Dis one follow as ADC don dey receive support from big opposition people like former Vice President Atiku Abubakar and Labour Party’s Peter Obi.

Di President yarn don make opposition fire back sharp sharp. People wey blast am include ADC, Coalition of United Political Parties (CUPP), and Mr. Paul Ibe, wey be media adviser to Atiku.

Meanwhile, for meeting wey happen for Presidential Villa for Abuja, Tinubu tell APC governors make dem put head for ground well-well to focus on development, security, and to carry people for grassroots follow body. E stress say make dem leave beta legacy of progressive governance.

Di President still lament say hardship too much for rural areas despite di money wey governors dey receive. E talk say make governors ‘wet di grass’, say make dem try reach ground level.

President still announce plan to build better national secretariat for di party for Federal Capital Territory (FCT). E talk say: “Make we leave legacy of development. 23 governors dey here wey go help identify land with FCT Minister. Make we form committee of progressive governors wey go find correct place for new secretariat. I believe say no wahala, di motion don carry.”

More Posts