Hosting of di 2026 Commonwealth Games dey under serious wahala afta di Australian state of Victoria don yan say dem no go fit host di event again because money kasala.
Di Commonwealth Games Federation (CGF) bin dey find am hard to get one city to host di games until Victoria come volunteer to host am for April 2022.
But di Premier of Victoria, Daniel Andrews, yan on Tuesday say di money wey dem go spend to host di games don triple and e don pass wetin di state fit manage financially. Dem bin first estimate say di 12-day tournament go cost 2.6 billion Australian dollars, but e don skyrocket to over 6 billion Australian dollars.
Di cancellation of di 2026 Commonwealth Games na big matter as e be say di games never cancel since World War Two. E go tough for di Commonwealth Games Federation to find anoda city wey go fit host di games.