President Bola Ahmed Tinubu go collect the new National Policing Bill on September 3 make e check am finish before dem carry am enter National Assembly. Presidency drop the gist on Monday and also launch one website wey go allow Nigerians send dia suggestions and opinion on top the State Police matter.
Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila, yarn dis one after one high-level meeting for Aso Rock, Abuja. According to am, dem don map out seven weeks serious work from July 27 reach September 14, 2026, to make sure say the bill strong and complete before e move forward.
Gbajabiamila talk say before Tinubu go give final green light, Nigerians still get room to yan dia mind through public consultations and memoranda wey dem fit submit online.
According to am, State Police na matter wey Nigerians don dey argue and discuss for many years, and the main goal na to carry security nearer to grassroots while still protecting national security and citizens’ rights.
E make am clear say although Senate and House of Representatives don already pass the constitutional amendment for State Police, the thing never become law because state Houses of Assembly never complete dia own approval.
E come warn say State Police no suppose turn political koboko for governors and politicians to pursue opponents.
The former Speaker still reveal say the final bill go contain better guidelines on funding, gun control, state readiness, implementation plans and other legal frameworks wey go determine how State Police go operate.
When dem ask am how much the project go cost, Gbajabiamila dodge mentioning any figure but insist say no amount too much if na to secure lives and property.
According to am, every state get different challenges, manpower and infrastructure, so the cost no fit be the same across board.
For states wey no ready or no get capacity to launch dia own police immediately, e talk say Federal Police go continue to hold ground until dem fit stand on dia own.
Attorney-General of the Federation, Lateef Fagbemi, still raise red flag say State Police must not become weapon for political vendetta and witch-hunt.
According to am, if proper checks and safeguards no dey, the arrangement fit create serious wahala for democracy and the country at large.
Ogun State Governor, Dapo Abiodun, explain say one major issue wey dem dey settle now na where Federal Police authority go end and where State Police authority go start.
If Tinubu eventually sign off on the bill by September 3, na another major step be dat towards making State Police become official reality for Nigeria.