President Bola Tinubu don stand gidigba talk say Federal Government no go ever bring out one kobo give kidnappers, and no criminal go collect freedom through blackmail or threat.
Tinubu drop dis strong warning on Thursday as e host Oyo traditional rulers wey Olubadan of Ibadanland lead come Aso Rock for Abuja.
According to am, government don know all di forests, hideouts and routes wey bandits and terrorists dey use, and security agencies don dey sharpen dia operations to flush dem out.
Di President reveal say di kidnappers no only demand money, dem still get mind tell government make dem release some gang members wey security operatives don already arrest.
But according to am, FG reject di condition straight-up.
Tinubu say many of di bandits don stain dia hands with innocent blood, and government no get any reason to soft-pedal with people wey dey terrorise citizens.
E still blame part of di growing insecurity on crisis wey dey happen for countries like Mali, Burkina Faso and Niger Republic, saying many dangerous elements dey find dia way enter Nigeria.
As e dey talk about di pupils and teachers wey kidnappers carry for Oriire, Oyo State, before security agencies rescue dem, Tinubu hail di military and congratulate Oyo people over di successful operation.
To tighten security more, di President say FG don begin increase military divisions from eight reach twelve so security response fit faster and deadlier whenever terrorists strike.
Tinubu still maintain say state police must happen, but safeguards go dey to stop governors or politicians from abusing di system.
E come talk say forest guards wey government dey train and equip no go just dey watch animals for bush again.
Meanwhile, three suspects wey security agencies link to di attack don bag life imprisonment after dem admit say dem hide information about di real masterminds and belong to Darul Salam terrorist network.
DSS also don drag five more suspects go court over terrorism, kidnapping and murder allegations. Court don adjourn di matter till September 24.
For Oyo State side, Governor Seyi Makinde don beef up security with two surveillance aircraft wey land di state on Tuesday.
Makinde say di aircraft, wey Oyo State buy alongside Nigerian Air Force, don already help security operations and intelligence gathering, especially for di Oriire kidnap case.
According to am, di planes don enter work immediately and go help security agencies monitor criminal movements, gather better intelligence and respond sharp-sharp to threats across di state.