After plenty dragging, political gbas-gbos, accusation and counter-accusation wey don make Osun State hot for days, Osun State Police Command don finally free Secretary to State Government (SSG), Chief Teslim Igbalaye, from police custody.
Na over alleged vote-buying matter security operatives bin carry am and five other people go detention, after police claim say dem recover PVCs, voters register and some cash from im residence during one operation wey scatter serious controversy for di state.
Chief Igbalaye and di other suspects spend several hours for police net before dem finally release am on Thursday afternoon.
According to police, di other people wey dem pick up alongside di SSG na Abiodun Arowomole, wey many people know as “Ashipa,” Taiwo Akande, Lukman Adeyemo, Muftau Olaoye and Musiliu Aderemi.
To make di matter heavier, police still allege say Ashipa dey among wanted persons wey security agencies don dey track over murder-related allegations.
But despite all di noise, allegations and political tension wey follow di arrest, Osun Police spokesperson, DSP Abiodun Ojelabi, confirm say Chief Igbalaye don regain im freedom.
Immediately news of di release land, jubilation burst for Adeleke political camp as supporters and members of di Imole movement begin celebrate, saying truth and justice finally win.
Many supporters wey bin dey condemn di arrest describe di release as victory for democracy and rule of law.
Imole Campaign Council spokesman, Pelumi Olajengbesi, no waste time hail Inspector-General of Police, Tunji Disu, and Osun State Commissioner of Police, Ibrahim Gotan, for wetin e call wisdom and maturity despite pressure from different angles.
E come add say Nigerian Police go continue earn public trust anytime dem choose justice, fairness and due process instead of intimidation and oppression.
Even though Chief Igbalaye don comot police cell and return to freedom, di wahala never completely end.
Police still maintain say investigation into di alleged vote-buying case, PVCs, voters register and cash wey dem reportedly recover from di premises still dey active, and security operatives never close file on top di matter.
For now, political atmosphere for Osun don cool down small-small after di release, but plenty people still dey watch with eagle eye as dem wait make police complete investigation and expose di full truth behind di controversial arrest.