Sweet belle don full for over 1,000 young Nigerians as Nigerian National Petroleum Company (NNPC) finally carry dem enter permanent work after dem spend one whole year dey undergo tough internship, training and serious performance test.
NNPC big oga, Bayo Ojulari, announce di good news and talk say na one major achievement for di company as dem don successfully absorb fresh young blood enter di workforce.
According to am, nobody use connection, long leg or godfather enter. Na pure merit, hard work and wetin person fit deliver make di difference.
E come make am clear say for dis recruitment, no be where person come from, tribe, religion or who e know matter.
Di NNPC boss explain say offer letter fit give person chance to enter di system, but na wetin dem do throughout di one-year programm make dem finally secure permanent placement.
Ojulari come advise di new workers make dem no just siddon collect salary. E encourage dem make dem bring fresh ideas, talk when necessary, challenge old ways and continue to improve themselves.
E still remind dem make dem no forget di journey wey bring dem reach where dem dey today.
Dis latest employment move come as NNPC dey try strengthen im workforce and prepare better manpower to drive di company forward after di oil giant transform into commercially-driven energy company under di Petroleum Industry Act.
Di recruitment exercise start under former NNPC GCEO, Mele Kyari, for 2024, and after one year of screening, training and performance checks, over 1,000 young Nigerians don finally land permanent work for di nation oil company.