Live on air

🎧 Listen Live 🔴

President Buhari don join fans to celebrate Tems as she win Grammy

February 7, 2023

President Muhammadu Buhari don join fans and lovers of Nigerian music to take celebrate new high points of say dem accept and value the Afrobeats singer, Tems as she win “Best Melodic Rap Performance” category for the Grammy Awards.

Buhari, for one wehdone message by him spokesman, Mr Femi Adesina, on Monday for Abuja sing the praise of Tems, Temilade Openiyi, as she put all her hand and leg to take carry her talent show the world with hard work.

According to am, dis matter na another one wey don make everybody to dey shine light for Nija on top excellence, e also clap hand give all the Nigerians dem pick for dis year Grammy, including Burna Boy, as dem dey pursue dea passion with energy and dem don redesign world entertainment with originality back-to-back.

E thank the creative industry, especially the managers, producers and directors as na dem dey ginger talents like Tems, wey don carry Nigeria culture and waka-waka to the world.