Live on air

🎧 Listen Live 🔴

INEC don yarn say dem go provide enough security for NYSC serving members during the general elections

February 3, 2023

The INEC Chairman, Prof. Mahmoud Yakubu don yarn us say the commission go make sure say dem get enough security for all National Youth Service Corps (NYSC) serving members wey dem go carry go cover the general elections round we country.

The INEC Chairman con dey tok yesterday as e go receive one group wey the Director-General of (NYSC), Brigadier-General Yusha’u Dogara Ahmed lead, e rub hand for chest give the DG say the comfort, security and safety of all corp members wey dem go carry go cover the election dey secured, e con dey declare say the general election go hold as dem plan am. Yakubu also tok say dem go train all corp members wey dem go carry cover the elections on top election matters before the 14th of February, 2023.

For the beginning, the NYSC DG, Dogara Ahmed also yarn us say dem dey train all corps members against fear dem fit get when dem face the crowd on Election Day.