Live on air

🎧 Listen Live 🔴

INEC Don Declare Alex Otti Winner of Di Gubernatorial Election For Abia State

March 23, 2023

 The INEC, don declare Alex Otti, the person wey dey drag the governorship seat for Labor Party (LP) inside Abia State, as the WINNER of the March 18th gubernatorial election for Abia State.

INEC on Monday, bin delay the collection of the governorship election results, after AGBEROS con attack dea officers for the Obingwa Local Government Area of the state. But, as the Collation Officer for the LGA dey declare the Obingwa results yesterday, e tok say Mr Otti collect one total of 175,467 votes to take flog Mr Tony Ahaiwe of the PDP wey collect just over 88,000 votes. 

For Enugu State, where INEC bin also pause the collation to take relook results from two local government areas wey con still remain  Nsukka and Nkanu East, dem declare Peter Ndubuisi Mbah of PDP the winner of the election, and also Enugu Governor wey dem pick.

INEC Returning Officer for the Enugu gubernatorial election, Prof. Maduebibisi Iwe, tok say Mbah collect 160,895 votes to take beat him nearest opponent, Chijoke Edeoga  of the Labor Party (LP) wey score 157,552 votes.