Live on air

🎧 Listen Live 🔴

INEC Declare Say Dem Never Settle Adamawa Governorship Election

March 21, 2023

 INEC don tok say dem never settle the March 18th governorship election wey happen for Adamawa State.

INEC explain say dis choice dem make na because of the amount of votes wey the pipo wey dey drag for the position record for the election. According to the election body, the votes dem cancel con plenty pass the amount of victory between the top two runners.

The present governor of the state, wey dey try win under PDP, Ahmadu Fintiri, collect 421,524 while the person wey follow am for back, the runner of the APC Senator Aishatu Dahiru Binani secure 390, 275. The amount between the two runners dey over 30,000 votes, wey according to INEC, na less dan the votes wey bin dem cancel.