Live on air

🎧 Listen Live 🔴

FEMA don save people for one building wey collapse for Gwarinpa, Abuja, others still dey trapped

February 3, 2023

The FCT Emergency Management Agency (FEMA) tok say dem don save nothing less dan 22 pipo so far as dem dey try clear dose wey still trap for one building wey fall yakata reach ground for Gwarinpa, Abuja.

 The agency Head of Public Affairs, Mrs Nkechi Isa, for one statement on Thursday, also yarn us say two persons wey hook for the building wey reach ground don peme.

She tok say one join-body team of FEMA, NEMA, FRSC, Nija Olopa, Nija Security and Civil Defense Corps, the department of Development Control, Abuja Metropolitan Management Agency and Red Cross dey the location to take save the remaining pipo wey the building wey reach ground don hook.