Live on air

🎧 Listen Live 🔴

CBN don order banks make dem pay the new naira notes over counter

February 3, 2023

The Central Bank of Nigeria don order Business banks make dem start to dey pay the new naira notes to customers over-the-counter for the banking halls.

 Na the bank Director of Corporate Communications, Osita Nwanisobi confam dis matter for one statement yesterday.

The top bank con dey tell Nijans make dem drink water drop cup as the lines for the Automated Teller Machines Stands (ATMs) go soon end too, while dem dey order the banks make dem pay new notes over-the-counter, wey dem bin block before.