American musician and songwriter Stevie Wonder has officially been granted Ghanaian citizenship status by President Nana Addo Dankwa Akufo-Addo on Monday, May 13, 2024.

American singer, Stevie Wonder, don be granted Ghanaian citizenship

May 14, 2024

American musician and songwriter Stevie Wonder don officially collect Ghanaian citizenship status from President Nana Addo Dankwa Akufo-Addo on Monday, May 13, 2024.

For one small meeting for Jubilee House, di popular singer wey dey for Ghana with im family afta e decide for 2021 to relocate permanently to di West African country, yan say e dey happy wit di honour wey dem give am, and now e go hold both im American citizenship and di one for Ghana.

Stevie, wey be person wey grow for Michigan, bin tok for February 2021 for one interview with Oprah Winfrey say e wan move go Ghana sake of di political trouble wey dey happen for United States.

Stevie Wonder, wey learn to play piano, drums, and harmonica wen e dey 9 years old and sign to Motown for 1961, don win 25 Grammy Awards, get one honorary award, and e don dey nominated 74 times.

For more news https://naija102.com/blog/

More Posts