Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Manchester City don close gap on Arsenal for di title race after comfortable win over Brighton

April 26, 2024

Manchester City knack Brighton 4-0 as Phil Foden score two goals wey lift di Premier League title chasers to just one point behind leaders Arsenal on Thursday.

Guardiola’s team, wey get one match for hand pass both Arsenal and third-placed Liverpool, go carry di crown as champions for di fourth time in a row if dem win dia last five matches.

Next game for City, wey never lose for 18 league games, na to waka go Nottingham Forest on Sunday, while Arsenal dey go face Tottenham just few hours before dem.

More Posts