Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Wofai’s wedding wan spoil as her in-laws reject di union with their son

May 6, 2024

Wofai Fada, wey be Nigerian Entertainer, fit dey face wahala for her marriage even before e start.

Na so di mata take enta another level of trouble, afta Wofai announce her engagement to Taiwo Olakitan Cole for her Instagram page on Saturday, May 4, 2023.

Just afta videos show for everywhere from di traditional wedding wey happen for Wofai village for Ugep, Cross River State, Taiwo family come release statement say dem no gree for di marriage between dia pikin and her.

Di statement wey Engr Kunle Cole sign on behalf of di Cole family, tell everybody say dem no even sabi about di traditional wedding and dem no give permission for am. Dem even warn say di couple no suppose dey claim say dem be part of Cole family.

More Posts