Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Federal Government wan integrate over 20% of unbanked Nigerians into di banking system

April 26, 2024

The Federal Government don talk say dem get plan to include over 20 per cent of Nigerians wey no dey use bank for di banking system.

Vice President Kashim Shettima reveal dis for Abuja yesterday for di beginning of one two-day National Stakeholders’ Workshop on Economic and Financial Inclusion.

According to di vice president, at least, over 20 per cent of Nigerians dey excluded financially as e dey now, while di government dey target to reduce dat number to at least five per cent.

For di event, di 14th Emir of Kano and former Governor of di Central Bank, Sanusi Lamido, tok say banditry and oda security wahala wey dey Nigeria, fit largely relate to financial exclusion as many pipo for rural areas no get access to better payment systems.

More Posts